EFCC Don Arrest Yahoo boy For Oghara Afta  $268,000 Wayo

EFCC don catch Precious Ojo wey pipo know am as Obago.

Ojo na 26 years wey dey for Oghara inside Delta State and na there dem take arrest am afta one Americana write give EFCC say pesin run am street.

Na the Head of Media and Publicity for EFCC, Wilson Uwujaren nai tok so on Wednesday.

The pesin say Ojo lie say hin na one Raymond Bush wey dey work for United States Treasury, naso he take play the pesin wayo kolet $268,000.00.

EFCC arrest Ojo for hin hotel for Oghara and say hin really kolet the monei , from am nai he take use build the hotel.

Dem still see different tins with am like white Mercedes-Benz with hin own plate nuba join with phones.

Uwujaren say dem go soon karey the Obago to court to judge the case.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM