+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Election 2023: Na You Worst Pass -FG, Afta Obasanjo Letter

 

Fediral Govimet don give strong warning to the foma President of Nigeria, Olusegun Obasanjo, say hin know how to tok make that letter wey Obasanjo write nor just cus problem for 2023 elections.

On Monday nai Obasanjo write as e dey do am for bodi about 2023 presidential election and say INEC don fail the kontri.

Obasanjo say na enough wayo nai full the election and why dem nor gree follow the 2023 Election even with the 2022 Electoral Act.

For statement wey the Minister of Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed, bring on Tuesday for Abuja hin say the foma President just dey use wayo take dey tok like say hin nor like make gbege come.

The Minister expressed shock and disbelief that a former President could throw around unverified claims and amplify wild allegations picked up from the street against the electoral process.

“Foma President Obasanjo na elder statesmana but if you look am well you go see say he dey wan part and na how to make the election nor work for million of pipo hin dey do,” nai he say.

Mohammed say Obasanjo nai even do worst election for the kontri pass for 1999 and he nor fit dey the shoe to advise president wey want make free and fair election dey for Nigeria.

As pipo dey wait for the Saturday result wetin elder suppose do na to use good words to take calm pipo instead he dey use letter dey wish for inconclusive election results, Muhammed say e nor just make sense.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM