Fediral government don clear ground on top election wen report say dem postpone because of insecurity.
The Minister of information and Culture, Alhaji lai Mohammed nai shook mouth for the mata for Abuja on Tuesday for inside the President Muhammadu Buhari Administration Scorecard program.
He say naija no get reason to fear as everi dey put hand to see say the election dey legit and peaceful.
“Where the federal government stand now na say the 2023 election go happen as dem plan am before,nothing don happen wen go change that one”
“We know say INEC dey work with security people to make sure say the election dey successful for every part of the country.
“Security people don also dey tell Nigerians say make their mind rest as them dey work to see say Naija do election for peaceful atmosphere.”
INEC been don talk say them go make sure say serious security dey for both election material and personnel.
As he dey talk for the validation of election security training resources on Monday,INEC commissioner and chairman board of Electoral Institute, Abdullahi Zuru con clear ground say Babagana Monguno wen be National Security Adviser don say dem go provide better environment so that the general election go dey successful.