The gbege wey dey samuka every where for the kontri, wey make am dey shake like table wey wan fall don make INEC say dem nor go do election for 240 polling units wey dey for 28 states.
On Monday nai the chairman of INEC, Prof. Mahmood Yakubu take tok so for meeting wey hin dey do with leaders for political parties.
Hin tok say; “For 240 polling units wey nor get voters wey dem register for Abuja and 28 states. Na from one polling unit to 12 polling unit for the states as FCT but for Taraba and Imo state reach 34 and 38 polling unit.
“No new pesin choose the polling units and no bodi gree transfer go there cus of insecurity. Nai be say election nor go happen for those polling unit.”
But Vanguard say the Inter-Party Advisory Council, IPAC, say make dem nor karey the election komot from the date wey e suppose happen.
Sani Yabagi from IPAC tok say “Mr chairman abeg una, make una nor shift the election.