Election Petition Tribunal Don Start For Delta

 

The National and House of Assembly elections petition Tribuna for Asaba don start to take motions for the 25 petitions wey dem get from eight senatorial and 17 House of Representatives pesin and dem party.

Senator Peter Onyeluka Nwaoboshi, wey be APC senatorial candidate for Delta North join the eight pesin wey bring case come say make the tribunal epp dem to change the result.

The tribunal seke, Okedara Adejoke, nai tell news pipo yesterday for Asaba say put of the 15 motions the tribunal gree for 12 den reject 3.

Adejoke tok say Nwaoboshi bring case against PDP Senator-elect, Nwoko Chinedu Munir, and INEC, while Delta South PDP senatorial candidate, Diden Michael, bring case against APC Senator-elect, Joel Onowaikpo, and INEC.

The Seke still say PDP senatorial candidate for Delta Central, Chief Ighotoya Amori bring against APC Senator-elect, Dafinone Ede Omueya, and INEC while senatorial candidate of APGA, Timinimi George Ugulasuowei, dey against Joel Onowaikpo and INEC.

Odas na: Oboro Evelyn Omavowan, PDP House of Representatives candidate, against Etanabene Benedict of LP and INEC; Eselemo Ukubokeyei Collins of NNPP petition Nicholas Mutu of PDP, Brikitamarankko Juliano of APC and INEC.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM