Nigeria Labour Congress, dey give warning to judiciary, especially election petition tribunals, make dem no do woruworu for the case wey dey before dem about the 223.
The National Chairman of the congress, Mr Joe Ajaero, nai tok so on Sunday for Abuja as dem dey news conference wey Labour and Civil Society Movement Front do to mark 2023 Workers’ Day.
He say as e dey go, labour and civil society movements go soon do ‘Hall of Shame’ for any judge wey go work against law as dem fon dey force leaders wey Nigerian nor meed put for dem hand.
Ajaero say e still dey shock am say election petition tribunals never still start even with the many case wey dey dem hand
“The judiciary don put many states and institutions for fire. Dem put Imo State for fire and up till now, pipo still dey wonder how pesin wey nor be candidate of hin party, dem declare am as govinor.
“The judiciary get plenty kweshun to ansa. And if dem nor fit ansa for small time, we go do Hall of Shame for those judges and e fit happen anytime soon,” wetin hin tok.