Empress Njamah Confirm Say God Nor Dey Slip As Police Catch Foma Boyfriend

 

George Wade the foma boyfriend of Empress Njamah wey dey act film, police don arrest am for Liberia.

Empress Njamah nai tok so for her Instastory on Monday with video wey police chain dey Wade hand, she come write “Our God nor dey slip.”

Njamah bin say Wade dey beat her and come even blackmail her afta dem relationship nor work.

For live video wey she do for her business page December last year nai she take say the  engagement video wey she post for her own page that same December, nor be clear eye she take post am.

She come still say Wade do her 419, beaten life komot for her bodi, dey show her pepper until she come for run.

Even afta she don fit run, Wade still dey threaten her say he go show her more shege.

Before pesin go say jack robinson, Wade don go put her naked video and pictures for one WhatsApp group wey bloggers and other pipo full. Untill now wey police don go catch am for Liberia.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM