Ritualist don dey terroize Oghara Kingdom and places wey dey around like the Koko junction pipo even the students wey dey for popular Saint Augustine’s College wey near Oghara main town.
Dem see one deadi bodi around the signboard of Saint Augustine College for the express road to Koko junction wey dem dey pass to Benin, and e don already dey smell, and pipo there don dey fear.
Sources say the deadi bodi wey dem cut the head komot na man wey dey craze and dem tik say na motor kill am for the express.
Pipo for the village dey always pass the road go dem farm, tok to tori pesin without dem name, say na ritualist nai kill the man.
Wey the principal of Saint Augustine College for Oghara Kingdom, Rev. Fr Immanuel Tugudu tok hin own, hin say the tin don make pipo dey fear cus of the way insecurity dey for the knotri and that one don make security tight for the skool cus dem nor wan hear sorry.
Deep tori inside the mata show say Fulani nama pipo dey turn around the bush but even say dem never report any kidnap, na dem dey tiff pipo for for Oghara.
Even the vigilante group for Oghara say dem must stop the evil wey the Fulani dey do for dem Kingdom afta dem rape two married women for their farm.
The Delta State Police Public Relations Officer, DSP Bright Edafe comfim and say policemen don go the area and go catch those wey dey involve, cus their eye dey red for where crime dey.