Fediral Govimet don write to Supreme Court make dem nor gree for the case wey three states for north bring against the February 10 date wey CBN put to take stop to use old naira notes.
For anoda case wey FG sign on Wednesday through dem own lawyers Mahmud Magaji and Tijanni Gazali, the attorney-general of the federation (AGF), dem say supreme court nor get the power to judge the mata.
The AGF still argue say the pipo wey karey the mata come neva show any beta resin against FG.
Remeber say on Wednesday nai one seven-member panel of Supreme Court wey John Okoro Lead, nai give the ruling to favour Kaduna, Kogi, and Zamfara wey karey the case come say make dem stop FG nor to put February 10 as the last day not to kolet old monie.
FG on dem own part with AGF say the case for start from Fediral High Court and nor be to rush go Supreme Court as the states do.