Fire Burn Auditorium for Mercy Land Church

 

Fire don burn Partners auditorium for Christ Mercy land Deliverance Ministry aka Mercy city wey dey along Warri-Sapele road on Tuesday.

One top staff of the church say the fire just start all of a sudden, and the first pesin wey see am say the church first explode before fire start to spit every where.

Wey tori pipo go meet the founder and Senior Prophet of the church, Prophet Jeremiah Omoto Fufeyin wey dem still dey call Papa J, he nor gree tok, he say make dem go meet the church seke.

The Head of Service of the church, Mr Okulayo Funfuye wey karey Vanguard go meet the Senior Prophet come later tell Vanguard say church seke don drive komot.

While some of the staff wey come tok, but say make dem nor call dem name , say na around 11 on Tuesday morning the fire start before fire fighters come off am.

Dem say no bodi die, even to get the church to tok no fit possible as even the Mercy Telly office line nor dey on.

For where the fire take happen you go see chairs and AC wey fire don already burn.

The fire burn everytin wey dey inside the church hall and members wey dey tok, say dem thank God say nor be wey service dey on nai the fire take happen.

Na only inside the church hall the fire burn e nor touch motor wey dey outside.

 

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM