Fire Burn Enugu EFCC Office

 

Enugu office of Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don catch fire burn tins down for the building.

One of the building for the Zonal Command nai the fire touch pass.

Nai Wilson Uwujaren, the Head of Media nai release statement on Friday afternoon to tok wetin sup.

“The fire accident wey happen around 12.30 on Friday morning , na light wey dem bring cause the spark wey come bring fire.

“The Enugu State and Federal Fire Service nai come battle with the fire to off am,” na wetin Uwujaren tok.

But he say no bodi kpeme for the fire.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM