Fire For Alaba Market As Jaguda Nor Gree Fire Fighter To Off The Fire

Pipo start to dey shout afta fire burn Alaba International Market for Ojo side of Lagos state.

Na Friday morning nai the fire start from one shop where dem dey kip gas cylinder.

As pipo wey dey sell see the fire nai only dem start to dey epp to off am before fire service go come.

Director of Lagos State Fire and Rescue Service, Adeseye Margret for statement come say wey dem reach to off the fire nai some jaguda boys come dey block the fire fighters make dem nor off the fire.

“Wetin dey enta Lagos State Fire and Rescue Service ear be say, shops wey dey for the popular Alaba International Market dey on fire.

“But the Fire Crew wey dey for Ojo, Sari-Iganmu and Ajegunle, boys wey dey vex say make the men nor go off the fire but dem still dey on ground.”

Adeseye say dem dey collabo with oda security pipo to make sure say sumtin gud come out from the situation.

Dem say na shops wey dem use kpako take build for the market nai the fire touch pass.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM