Five pipo wey dey stay for Abuja don karey attorney-general of the federation and the chief justice of Nigeria go court cus of say dem wan put Bola Tinubu as the president of the kontri.
Dem say na cus Tinubu nor get the 25 percent of votes for FCT.
Na April 28 nai dem file the case for Fediral High Court Abuja.
Those wey karey case go court na Anyaegbunam Okoye, David Adzer, Jeffrey Ucheh Osang Paul and Chibuike Nwanchukwu and na only dem bring the case on behalf of pipo wey register and vote for FCT.
Dem dey ask court weda the pesin wey suppose be president must get 25% of vote for FCT according to the way law tok am.
Dem come tell the court say if the kweshun na yes, then make court make sure say any candidate we nor get 25% of votes for FCT during the February 25 election, make dem nor put am as president.
The five of dem still dey beg the court make dem make President Buhari stay for office for office untill the next pesin go come take over from am according to wetin constitution tok.
Dem come still say make the court put for one side the certificate of return wey INEC give Tinubu and stop the CJN and any other judicial officer make dem nor swear in any president or vice untill the court settle the case.