+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fuel And Monie Don Bring Anoda Protest For Ibadan

 

Some pipo wey dem neva know who dem be don go block the busy Eleyele junction for Ibadan North-West LGA for Oyo State, say dem nor go gree again as no monie and no fuel.

Remember say on Friday February 3 nai protest happen for Ibadan and some jaguda for Araromi Spare parts and Gate use the opportunity take burn one police station, tiff dem plasma TV, destroy WEMA bank for the area and even tiff from shops wey dey the road.

The today protest don cause serious hold up for the popular Eleyele, and pipo wey dey come from Eruwa-Ologuneru nor fit pass to go where dem wan go.

Punch tori pesin say motor don dey turn back and children wey dey go skool dey go house back make dem nor go attack dem.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM