+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fuel Go Sell N400 Per Litre Afta Subsidy Don Komot, PENGASSAN

Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria wey be PENGASSAN say afta dem don komot fuel subsidy, filling station go dey sell from N360 and N400 per litre.

The president of PENGASSAN, Festus Osifo nai tell news pipo for Abuja afta dem do national executive council meeting on Tuesday.

FG don say dem go spend N3.35 trillion for petrol subsidies, then dem go komot am for June this year.

Osifo say the afta dem komot the subsidy, na the foreign exchange rate wey NNPC take buy nai go tok how much dem go sell.

PENGASSAN president say dem don tell all Dem association for the kontri make dem make sure say pipo see fuel buy.

Osifo say w go beta if refineries dey work, cus na only so e fit reduce the monie wey pipo go pay and even give work to those wey nor get.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM