+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fufu nai be the secret of my speed – Karim Adeyemi

 

 

Borussia Dortmund star,Karim Adeyemi don talk say the secret to him speed for field na African food, especially fufu.

The Germany striker wen still come from Nigeria score the only goal for Dortmund wen Dortmund play against Chelsea for the Champions league round 16 first-leg for Signal Park.

For one interview with CBSSportGolazo, Adeyemi talk say he dey eat Nigerian food wen dey make am get speed.

“I dey eat pleanty African food”.

“I get better gene from my papa so I think say e no go easy.

When dem ask am the exact food when he dey eat, Adeyemi say “Na fufu be the name and na Nigerian food wey dey very good.”

When dem ask am say wed ana him be the fastest player for Germany, he busrt laugh say “I no know o.”

Adeyemi wen be 21 years old score koret goal when he kolet the ball from him own half of the field con run almost the full field even pass Enzo Fernandez for speed before he thruway the Keeper for one side con put the ball inside the net.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM