Pipo wey dey for Udu LGA now don dey fear afta one petrol tanker fall walaka with everytin wey e karey for the area.
For fear make fire nor go start, all the pipo wey dey under the bridge dey sell and pipo wey dey pass the bridge don zab.
Tori say the truck fall block the bridge so that drivers nor fit reach Sedco side.
Even pipo wey dey go back to Ovwian, Owase, Jigbale and the rest, nor fit pass cus of the fuel wey pour for the bridge.
We neva know wetin make the petrol tanker fall by the time this tori dey drop.
But by now serious hold up don dey for the bridge like this, this one don make pipo dey look for oda road to pass.