Gree Say Sheriff Win You, Call To Congratulate Am – PDP To Omo-Agege

 

 

The tokpesin of PDP Presidential Campaign and Delta State Commissioner for Information, Mr Charles Aniagwu, don dey tell Deputy Senate President wey be APC govinorship candidate, Senator Ovie Omo-Agege make he gree say dem win am for the election and just congratulate PDP and Sheriff Oborevwori.

For statement wey Aniagwu write nai hin take say: “The House of Assembly and Govinorship election for Delta State follow the due process and nor be the wrong tin wey APC dey karey say happen.

“The result so na from the different units, wards and local govimet dem take calculate am, and the winner don come out free and fair.

“APC win 6 State Constituencies, dem nor go fit come tok say the election nor follow the Electoral Act 2022 wey dem amend.

“We thank Delta pipo as dem stand with PDP and even ready to stand with Okowa mandate till the end.

“We dey use this medium to call APC Governorship Candidate and Deputy President of the Senate, Senator Ovie Omo-Agege to wetin pesin wey stand with democracy suppose do and call hin broda Rt. Hon Sheriff Oborevwori to congratulate am for hin victory.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM