
Greece don give Nigeria one million dose of Johnson and Johnson COVID-19 vaccine vaccine, make the kontri use take fight the pandemic.
Na on Monday for Abuja wey Greek Foreign Affairs Minister, Nikos Dendias, go visit Nigeria Minister for Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama na there hin take talk so.
Dendias say na way wey Greek govimet take dey support Nigeria cus this COVID-19 don teach the world say every bodi nid demsef.
He come tell Nigeria say make dem nor fear the vaccine neva expire.
For Onyeama side, he thank Greek govimet for dem epp to Nigeria, and say the knotri go use the vaccine well.