+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Group Stamp Omo-Agege As Govinorship Candidate For March 11

 

One group inside PDP for Delta State wey be Delta Unity Group (DUG) don stamp Senator Ovie Omo-Agege, the APC govinorship candidate for March 11th election for the state.

DUG get top politician for the group and na dem bin support foma PDP govinorship pesin foma  commissioner for finance, Olorogun David Edevbie.

Dem form the group to make sure say Olorogun Edevbie be govinor and pipo wey dey the group na foma speakers of Delta State House of Assembly, foma Seke of State Govimet and foma commissioners wey dey loyal to foma govinor for the state Chief James Onanefe Ibori.

Afta dem meeting on Monday for Agbor, nai the group say na Omo-Agege nai dem want.

Na the Chairman, Board of Trustees of  Delta Unity Group, Prof. Patrick Muoboghare; Chiedu Ebie, Esq. and Chief Itiako Ikpokpo nai sign am for the meeting.

The statement say na afta dem don look the mata for weeks nai dem take put Omo-Agege as the pesin wey dem want.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM