Fediral High Court for Abuja give INEC order make dem gree use Temporary Voter Cards, TVC, for the govinorship election wey go happen on the 18th of March 18.
Na Justice Obiora Egwuatu nai give the order on Thursday afta two pipo karey the mata go court say dem wan use TVC as PVC nor dey.
Naso Justice Egwuatu come say as long as INEC don register and capture, dem data suppose dey for INEC data base before election.
The judge say hin nor fit ansa prayer three wey say make any bodi with TVC vote cus the case nor come the court like that.
The court say but according to the law no part of the 1999 Constitution and Electoral Act tok say na only PVCs nai dem go use for voting as the law still provide for voter’s card.