Gunmen Don Kill Two Police For Ekredjebor

Some ole boys don go kill police officers wey dey for Ughelli Police Command for inside Ekredjebor community, afta dem shoot the police come still injure anoda one.

The tori be as e get cus the full jist neva drop, but the police officers dey shoot war start kill and go with the arm robbers for Okoruwe Street wey dey near winners junction, for Ekredjebor on Friday night, na there arm robbers shoot police down.

The officers wey fall na Ujeyah Matthew and Sgt. Ijebu, then the other one name nevar still clear.

Wetin on pesin wey dey stay for the area tok, but nor call hin name say, “No be small gunshots nai we hear for Ekredjebor road, near Okoruwe street wey be Winners junction. Two men wey we tink say na police dey ground near the speed breaker.

The source say, “E be like the pipo the pipo wey kill the police men na arm robbers, the officer wey dem kill nor karey gun near bodi, e clear say the tiff don run with the police dem gin. The tin happen for Ekredjebor road, near Sokaje hotel, Ughelli.”

Na for April 27, three weeks back nai tiff pipo tiff one police inspector Ifeanyi, the next tin na hin deadi bodi nai dem see the next day for Evwreni forest.

As of now the Delta State Police Public Relations Officer DSP Bright Edafe nevar tok about the mata for public, but one senior security pesin for the State Command confirm wetin happen.

He say, “Two Police Officers nai die, then Sgt. Ijebu dey for hospital dey take  treatment.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM