The Foma Minister of Education, Obiageli Ezekwesili say he nor like the way Ghana pipo dey form dey claim any Nigeria pesin wey the world dey celebrate.
For wetin Ezekwesili write for Twitter on Monday, she say na from Tiwa Savage own she take notice am now dem don dance am reach Hilda Bassey.
Remeber say Tiwa Savage go sing for King Charles III coronation ceremony and na she be the first Nigerian artiste wey go get that kind invitation to come perform for foreign royal coronation ceremony.
But some Ghanaians dey claim for internet say she from Ghana now dem don reach go Bassey side wey don break Guinness World Record for pesin wey cook for many hours.
Na wetin she write be this “E nor do for Ghana pipo to dey drag Jollof Rice with Nigeria. I see say dem don still form the habit to dey claim awa best tins too. I see am with Tiwa Savage now dem don dance am reach Hilda Bassey side.
“E dey make pesin dey laugh. How we take even start all this? E dey wonder pesin!”