Pat Utomi don tok hin own about the PVC wey two hunters see for forest inside Anambra state as the election on Saturday dey come.
Na two hunters wey dem nor call dem name nai see bag full of PVCs inside one forest for Akamili, one community for Nnewi.
On Tuesday nai the hunters see the bag come karey am go Authority FM radio station for the state.
Utomi say e go good make INEC find solution to this problem even repost pipo again.
For Arise Television Morning Show on Thursday nai Convener of BIG-TENT, the coalition of Political Parties, Social Movements and Civil Society Organisations for Peter Obi-Baba-Ahmed Datti, Utomi come say: “Wetin be the solution wey we get, but if INEC get sense dem go repost pipo again.
“If dem get sense to make everytin go well. As we dey look, we nor dey expect perfect result, we go use the module and this one nai go epp kip Nigeria make e dey work and bring progress to pipo.”