Some Kidnaper don go tiff one husband and wife for Osogbo-Iragbiji Road wey dey Osun on Saturday as dem dey come back from church program around 4:00 for morning.
Dem say the man and hin wife bin dey ride dem okada wey all of a sudden dem jam the kidnapers for road.
The Police tokpesin for Osun, SP Yemisi Opalola, nai tell news pipo for Osogbo on Monday and say dem dey do dem best to find the kidnapers.
According to NAN, dem don send hunters and police make dem dey find the forest for the area to fit save the husband and wife.