The senator wey dey rep Borno South Senatorial District, Ali Ndume, don karey hand nack ground, back chest say hin musrt challenge the $800 million loan wey oga Presido administration wan take.
President bin go meet Senate make dem approval $800 million as borrow monie to use take do the National Social Safety Network Programme.
According to the President Buhari the monie na to use take gibe poor pipo wey dem finally komot fuel subsidy.
But Ndume tok for interview say lie lie, that kind leg nor folow at all.
“I go enta court cus this na just wayo wey nor even folow constitution. Make.i give you on example, we are be two here and you say you one borrow one million share share for the two of us, how you want take select awa two?
“If you give Nigerian pesin today ₦4,000 how that one take epp?
“All these guys go just use big English take baba Buhari and he just approve. Buhari nor understand, dem just wan tiff the monie and we nor go sitdon look.
“Wetin dem dey target na wetin dem wan get, anybodi wey come Tv come challenge me, I go still come back to explain myself, Dem just dey show president bad road, na wetin Ndume tok for Trust Tv interview.