I Nor Dey Owe You Anytin – Tinubu Tell Wike

Asiwaju Bola Tinubu wey go soon be president don tell Govinor Nyesom Wike for Rivers State say hin nor get anytin wey he dey owe am but Wike get to rub hin back to kolet sumtin from am.

Na wey Tinubu go Port Harcourt on Wednesday to open Rumuokuta Flyover nai he take tok so as he reply wetin Wike ask say make FG return the monie wey states take do fediral roads for dem state.

Wike don bin tell president elect say dem don spend N80 billion to take do fediral road and na Julius Berger construction company nai dey do the road so dem do am well.

He say: “Julius Berger dey do beta work. We still dey make Emohua, East West, to Degema Junction wide and na JB still dey do am.

“How much dem bill us? Like N80 billion. We get to take N4 billion from awa own state cash every month so that we go finish the road before one year and six months. Nai make we never fail to complete awa project.

“But bad as e bad reach all this road na FG get am. We nor want make awa pipo suffa. I believe say FG go say make we return dem monie.

“I dey tell you say, as you enta office then stamp make dem return all this monie back, other state go mitate us. So na to return the monie nai be the first time wey we dey ask from you.”

As president elect come dey reply Wike, hin say: “For wetin you dey ask make I return monie, I nor dey owe you anytin..Na you dey stay for all this road. I like wetin you dey do. You go rob my back to kolet from my hand.”

But Tinubu still tok about he padi with Wike: I don already promise say I go come Rivers state and I don come. If you tok about karata, Govinor Nyesom Wike pesin fit depend on you.

“Inside Wike, I see man wey dey stand by wetin hin tok. He stand say the president must come from south. And he get mind stand for wetin hin tok, nor even mind weda pipo go vex.

“Him na really man wey get integrity. You dey stand with unity, make sure say tin dey open, make sure say justice dey.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM