+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Nor Use Delta State Monie – Gov. Okowa

 

Govinor Ifeanyi Okowa say hin nor buy any property with hin name or use pipo name take buy for hinsef.

For press briefing wey govimet do yesterday as dem dey commission the new Govimet House Press Center for Asaba nai hin take tok so.

As dem dey for the 370 capacity press centre nai Okowa say as dem join Asaba International Airport and Delta Transport Services, wey dey run Delta Line, he say na to make cost reduce and make sure say dem still manage the business well.

Okowa tok say: “Today, govimet don free as the big monie wey govimet dey spend don komot as tye companies sef go mange tins well.

“I nor know the airport land man wey dey give pipo right to fit get space inside until he come sign sosme paper work and na even south west hin come from.”

The govinor come still tok wetin hin administration don do for the seven years wey dem dey for power and other pipo nor dey see am.

“Govimet don build and still dey build bridge cause dem want beta tin. Like the ones for Beneku Bridge, Orere Bridge, Ayakromo Bridge and others.”

He come still tok about the 1000 kilometres storm gutta for Asaba wey dem dey still do for Warri.

The govinor come still dey thank news pipo as na dem dey bring the work wey hin dey do come out so that pipo go see am.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM