+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I See Shege For DSS Hand For Six Hours, Fani-Kayode

 

 

 

Femi Fani-Kayode, the foma minister for aviation don tok afta DSS invite am make hin come on Monday about the tweet of coup.

Fani-Kayode tok for hin Facebook page on Tuesday morning say nor be small shege hin see for DSS hand for six hours.

He say DSS come allow am go house but make hin come back to dem on Wednesday.

“Na tough experience even though the panel wey ask me kweshun dey nice and know dem work but e nor be easy sometin.

“Dem bail me and say make I come back on Wednesday.”

Wey Fani-Kayode come dey thank the presidential candidate of the All Progressives Congress, APC, Bola Tinubu and the rest hin say, “I really shock the way hin show me love.

Remember say we tell you here before say Fani-Kayode DSS arrest am cus hin tweet say Atiku Abubakar, PDP presidential candidate dey plan coup with other military pipo.

 

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM