+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

If you wan serve Nigeria, ready your mind for the worst – Buhari

President Muhammadu Buhari don talk say anybody wen get mind to serve Nigeria must ready for the worst.

According to Femi Adesina, the presido spokesman, Buhari talk this one on Monday for one state banquet for Damaturu, Yobe state.

When presido dey talk about hin fight against corruption, e con say “e no easy” for this system wen Naija dey operate.

“For north-east,God don help us clear Boko Haram; the economy don pick up and some people dey ask me wetin I don do for my promise to fight corruption”

“As e be,for this system wen we dey,to fight corruption no easy. Wen I dey military as head of state,I put some people for prison based on say constitution talk say you must show your assets and people wen no fit explain their own, I put dem for prison. Las las, dem con put me for prison too.

“So if you wan serve this country, you must dey ready for the worst. One thing wen I dey thnk God for be say nobody fit blackmail me.

Presido Buhari con still yarn say hin no get any land outside Nigeria,say hin plan na to stay Naija after he comot for office.

“I no get one square inch outside Naija and I wan stay for Naija when I retire from public office.

“As I talk before more than 30 years back,we no get any country like Naija. All of us need to stay here and save am together.

Between 2003 and 2019, I visit all the local government areas wen dey the country. For 2019 when I dey wan come back as presido, I visit all the states and the number of people wen come out con see who this Buhari be sef pass wetin person fit pay for or force.

“So I thank Baba God say Naija people sef understand me then and I make promise say I go serve God and Naija people.”

This gist dey show weeks after presido Buhari tell King Charles III say hin no get house for United Kingdom.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM