The Inspector General of Police for Lagos, Usman Alkali Baba say make dem go arrest Seun Kuti wey dey sing song cus he go beat police officer.
Na the Police tokpesin Olumuyiwa Adejobi, nai tok so for statement say afta the oga kpatakpata see the video wey Suen dey slap push the police officer on Saturday nai he take tok so.
But for Seun Instagram story on Saturday night, he say the police wan kill him and he family.
He say he get proof, but the pesin down beg am and he nor go karey the mata go court .