+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

INEC Nor Gree Make We Check Dem Portal, Peter Obi

 

Labour Party presidential candidate, Peter Obi open up to say the Independent National Electoral Commission, INEC, nor gree allow dem party to look the election materials wey dem take use do the February 25th President and National Assembly elections.

Peter Obi say hin dey go court today Wednesday with hin lawyers to challenge INEC why dem nor gree allow dem check the election materials, and na that waka make am nor fit go for the campaign of Labour Party govinorship candidate wey go happen on Saturday March 11, 2023.

He say make pipo wey dey support am stand with LP candidate to vote dem, but make dem vote candidate wey get beta character and get mind for the pipo.

“I suppose start awa stop campaign for Govinorship and State Assembly candidate today. I suppose go Nasarawa, Lagos, Enugu, Abia, Delta, Edo, Rivers, Plateau, Borno, etc.

“But as INEC nor gree allow us check the BVAS , I dey go court today with awa lawyers.

“As we dey follow the rule of law, I want make all OBIdients dey campaign for awa candidates like dem Gbadebo Rhodes Vivour for Lagos, Chijoke Edeoga for Enugu, Patrick Dakum for Plateau, Alex Otti for Abia, Ken Pela for Delta, Ibrahim Mshelia for Borno, and the others.

“Make I still make am clear to Obidients make dem vote for candidates wey get somtin good for character. I still stand to get awa mandate back.”

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM