Govinor of Delta state, Sen. Ifeanyi Okowa bus wey karey news pipo don get accident for Warri-Asaba road, with many of newsmen wey injure inside.
Na yesterday evening along Ogwashi-Uku-Ibusa road near Admiralty University nai the bus from the convoy take run enta inside bush.
Pipo wey karey eye see say the Press Bus wey dey follow the convoy just lost control immediately one of the tyre jump komot, naso e start to dance enta inside bush.
“The bus dey come from Warri, as e reach Ibusa side, nai the bus forget esef as the tyre just pull komot. All this one dey happen afta the bus don tumble reach how many times.
But the news men wey wound dem rush dem to hospital for treatment.
1 Comment
Chaii, it is well
Thanks for the update..
Keep up d good work..