Just In: Abia Assembly Members Don Serve The Speaker Breakfast

The Speaker of Abia State House of Assembly, Rt. Hon. Chinedum Orji dem don serve am breakfast today Tuesday around 9: 00 for morning.

Na 18 members apart from two, nai put dem signature make komot the speaker from seat.

The first pesin wey say make dem serve breakfast to the speaker na, Hon. Solomon Akpulonu then Hon. Chijioke Chukwu from Bende North come second am.

The main resin why dem impeach the speaker never clear but e nor dey far from wetin dem tell the speaker say make hin sack govinor Dr Okezie Victor Ikpeazu.

Even the deputy Speaker for the Assembly, Ifeanyi Uchendu wey dey rep Ohafia South confimate wetin dey sup to tori pipo for Umuahia.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM