Gunmen don kidnap the Federal Commissioner of National Population Commission, Gloria Izonfuo wey dey Bayelsa State.
Dem say na for Ogbakiri junction for East- Wear road for Rivers state nai the kidnapers take tiff Izonfuo.
Tokpesin of Rivers State Police Command, Grace Iringe-Koko nai tell Dail Post say na on Sunday evening nai dem tiff Izonfuo with her house girl and driver.
Dem tok say she bin from Brass dey go Port Harcourt.
On Monday nai the pipo wey tiff her call her family say make dem bring N500 million before dem go free dem.
The tokpesin of the State Command say Commissioner of Police don send pipo to make sure say dem find her and notin touch her.