Govimet of Kogi State on Friday say dem go arrest and punish anybodi or business pesin wey reject the old monie.
For wetin the Commissioner for Information, Kingsley Fanwo release hin say he happy as Nigeria pipo get epp from Supreme Court.
He say afta the judgement wey the court give, e nor go make sense say some pipo and business pesin still nor dey gree kolet the old naira notes.
The statement say: “If you reject the old monie that one na just same to say you nor dey obey Supreme Court.
“Anybodi wey nor gree kolet the old monie make dem report am to security and govimet and sharply the pesin go hear word. And any bank wey nor gree kolet the old monie, we go close am.”
Fanwo say the govimet nor go take am easy with any business wey dey kolet monie, and korokoro nor gree only wetin court tok.
“Since na the banks dey give the old monie, dem go still kolet am. We nor fit dey kill awa sef afta supreme court don give us freedom.”
The statement come say dem don set committee wey go make sure say pipo follow wetin court tok.