Govimet for Lagos State say make dem sharply close Chrisland Skool wey dey for Opebi inside Ikeja, afta one of dem student wey be Whitney Adeniran die.
The Commissioner for Education, Folasade Adefisayo on Sunday, nai say dem go close the skool untill dem go do investigation finish on wetin kill the piken.
The official send condolence message to the family and friends the girl, make God allow her rest well.
Adefisayo, say make pipo relax as dentgo make sure say dem fish out the issue come out.
The 12 years piken papa for social media say dem must know why hin piken die.
Michael Adeniran the papa of the piken say the daughter nor bin dey sick or get any sickness for bodi wey the skool bus come karey her to go the inter-house sports on Thursday.
The mama of the piken say the skool tok say na heart attack nai kill her piken but wey dem rush the piken go hospital, she say the lip and tongue of the piken black and her bodi soak with water.
According to Vanguard some of the students tok for WhatsApp chat say na electric from one ice cream machine nai shock her, as dem just see the way she shout jump for ground.
As dem nor nor wetin to do before the skool nurse come nai dem start to pour water for her bodi.