Lai, The Monie You Take Go Washington For Reach Build Classroom For Nigeria – Peter Obi

Mr. Peter Obi, the Presidential Candidate of Labour Party, Mr  Peter Obi dey tok back to Alhaji Lai Mohammed the Minister of Information about the allegation wey hin tok for dem head.

Na for April 4th nai Mohammed point finger to Obi say hin dey do tins against the kontri benefit, wey he go Washington DC dey follow some international media organization tok

Mohammed say Obi and hin running mate, Datti Baba-Ahmed tok against the good of the kontri say dem must to use lawyer take kolet dem mandate

He say wetin Obi tok just show say hin no be wetin pipo tik say hin be but na just to show pipo how he so much wish say na him win.

But wey Obi dey reply Lai on Monday night for AriseTV about Lai Mohammed journey to Washington DC nai he take say na financial jaguda.

He said: “Lai Mohammed dey call me say I dey do treason, wetin dey against the land, that one na just jaguda attitude. Me wey dey Onitsha but he travel go Washington DC go tok that kind tin. Na waste of govimet monie I call that kind behavior, that same monie go build many classroom.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM