Lamidi Apapa Disturb LP Hearing For Court

The Former Deputy National leader Labour Party, Lamidi Apapa enta court for the petition tribunal nai the obidient pursue him and he paddi dem komot from court.

Lamidi just karey hinsef go sitdon for the side wey Abure pipo dey, na from there the others over power am komot from court.

E nor tay nai Julius Abure lead Peter Obi enta inside the courtroom and na so pipo come dey shout.

But dem come still tell Apapa make he stop as he dey try stop Mrs Dudu Maluga wey be the National Women Leader for LP as she dey introduce herself say she dey stand for LP.

Maluga nor gree ansa Lamidi, she still introduce hersef but court come say LP nor get any bodi wey wan represent dem since dem no know who wan represent dem.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM