Leave The N725m And Houses, Court Order Foma NIMASA Chief

Fediral High Court for Lagos don give order make Patrick Akpobolokemi, the first foma Director-General of Nigerian Maritime Administration and Safety Agency, NIMASA, give out the N725m and oda of hin land property wey dey connected to am

The property dey for Plot J 37A 218 Close, 2nd Avenue, Banana Island and Ikoyi for Lagos state.

EFCCnai say all the property wey Mr Akpobolokemi get, na wayo means hin take get am.

Na judge Tijani Ringim nai give the order afta EFCC bring one ex parte application from dem lawyer Bilikisu Buhari on Monday.

EFCC tokpesin, Wilson Uwujaren come say make dem tell court to give dem go ahead make dem put the property for newspaper to see anybodi wey one buy the property before the 14 days wey dem go come back to court.

The lawyer say make the selling of the property favour FG.

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM