The foma Liberia president, Ellen Johnson Sirleaf, don delete Twitter message wey she take dey congratulate, Bola Ahmed Tinubu as Nigeria new president elect.
Sirleaf go tweet dey troway salute give APC presidential candidate as hin come out as winner for the election.
She come still dey congratulate Nigeria pipo as dem try to come out come vote for who dem want make e be dem president.
But the resin why she come go delete the tweet afta she don write am before nai come still dey wonder pesin.
Wetin dey the tweet na : Congratulations to @officialABAT for the victory wey you get for #Nigeria, and to Nigerian pipo as una come out to vote e good. I deg encourage the new President make hin look out to epp champion #WomenLeaders for hin govimet and make sure say women and girl na nuba one for your govimet.”