One woman for Ogun, Abeokuta don use fire take burn hersef die cus she nor fit pay back the N70,000 wey she borrow from microfinance bank.
The woman dem know her as mama Dada for Oke-Keesi for Itoko area inside Abeokuta wey she dey stay.
Dem say she kill herself cus no fit face the disgrace wey dey come meet her as she nor fit pay the 70k wey she borrow.
Na for weekend nai the woman send her last born boy piken make hin go buy fuel, then drive the piken outside, lock hersef inside them turn fuel everywhere come on the fire.
Report tok say dem don karey her deadi bodi go mortuary for the State General Hospital for Ijaye, Abeokuta.
With the way tins hard, many pipo wey dey borrow monie and nor fit pay dey see beta punishment from where dem borrow monie from. As some dey sleep for station even toilet.