
No be love dey do me naw, I don even tell God say I nor wan love any pesin again, this na wetin Inetimi Timaya Odon, wey we know as Timaya talk for hin Twitter page after small social media gbege sup with hin baby mama and actress Caroline Danjuma.
Timaya wey come from Odi, inside Bayelsa nai still get DM Records Limited. Even though say hin don call himsef as the best papa but e say love don clean komot for hin book and eye.
All this tori sup, afta Timaya piken mama go dey tell Caroline Danjuma wey dey act film make she nor dey feel say she special.