+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Vote For Omo-Agege – Ugwumba

 

Chieftain of the All Progressives Congress, APC in Delta State, Dr Rukevwe Akpedeye-Ugwumba, chieftain of APC for Delta State, on Thursday dey tell pipo make dem come out on Saturday to vote for Senator Ovie Omo-Agege the APC guber candidate.

Ugwumba tok so wey she dey follow tori pipo dey tok nai she dey put am for Delta pipo bodi make dem make sure say March 18 dem vote Omo-Agege, say na APC fit karey the state go forward.

She tok say Senator Ovie Omo-Agege dey come with program wey go epp pipo and na every where for the state nai the development go touch.

The chieftain say nor be true tok say Senator Ovie Omo-Agege dey look one side pipo pass as some pesin dey yarn, she say the BAND and EDGE agenda of Senator Ovie Omo-Agege na just to make pipo life beta

She say Omo-Agege enta the govinorship race to see say beta change happen for Delta State.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM