KLM Royal Dutch Airlines Boeing 777 just see one man wey die for dem airoplane wheel well on Monday
According to Belgium Aviation24, na from Lagos nai the plane take fly, and dem neva still know how the man take enta the plane before dem come see hin deadi bodi.
Dem say e go be say na cus the man lost too much heat from he bodi nai kill am.
The Royal Dutch say some pipo wey dodge enta plane tiye sometimes nor dey die.
One of dem tokpesin say “Bad tin fit happen wey the temperature fall.
“For flight journey wey far, the temperature fit even go down pass minus fifty degrees, and human being nor fit survive am.”
The Royal Marechaussee nai be the national force for Netherlands, and dem dey do both police and military work.