Man Wey Karey Onanuga Go ICC Say Hin Get Evidence Against Fani-Kayode, MC Oluomo

One Professor Gideon Christian don petition  International Criminal Court (ICC) make dem  investigate the election and afta election kasala against Bayo Onanuga the tokpesin of president-elect, Bola Tinubu.

He say new evidence don dey against Femi Fani-Kayode and Musiliu Akinsanya, wey be MC Oluomo, to show say dem cus some ethnic problem.

Christian say hin go still send anoda communication go give ICC say make dem investigate Fani-Kayode and MC Oluomo.

Na Twitter post wey Christian do on Monday nai hin take write am.

Know say hin don bin write petition make ICC investigate wetin happen before the election and afta the election join with wetin Mr Bayo Onanuga tok.

But the man don say hin see anoda tok wey go fit cause ethnic gbege.

He write say “Since my last letter to @IntlCrimCourt evidence dey suggest say @realFFK & MC Oluomo hand dey for the ethic gbege wey happen. So I go send anoda communication to ICC make dem investigate and prosecute dem.

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM