+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

My Piken Neva Die For USA- Nyesom Wike

 

Govinor Nyesom Wike of Rivers state and hin govimet don come out to say the tori for social media say dem kill Wike son for United States na big lie.

Na the State Commissioner for Information and Communication, Chris Finebone, nai say the tori wey dey parabulet for social media say dem shoot Wike son die for US cus of the presidential election on Saturday that one na just big ogbolor.

Dem write for the post like this ‘Breaking news: Dem shoot Wike only son die for California, US cus of hin papa way for Rivers election’.

But for statement wey the govimet call ‘Yet again, anoda lie’, wey dem send go give news pipo for Port Harcourt on Wednesday, say the govinor nor get son piken nor to tok of the one wey dey for United States.

That the post na just the handiwork of wicked pipo wey wan destroy the image of the state govinor.

Part of the statement na: “This na lie from bad belle pipo. To make am clear Gov. Nyesom Wike nor get any boy piken for US. By the grace of God the govinor children dey fine.

“This witch rumour na just to show how wicked pipo wan scatter the image of the govinor.

“Make una nor resin am, just troway the news for dustbin.”

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM