As Saturday na the election for president and House of Assembly pipo, Independent National Electoral Commission say the total pipo wey go vote on Saturday na1.6 million
The Resident Electoral Commissioner, Dr Gabriel Longpet wey be the Resident Electoral Commissioner for Kogi nai open up tell news pipo on Tuesday as hin dey tell dem say INEC don ready for the election.
Hin say “We get to know say some of the BVAs fit nor work during the election. Dem don give us anoda 250 BVAs machines to take change those one wey fit get problem on the election day.”
He still say INEC don send materials go all LGA.
Longpet say the commission done get different report of some political parties wey dem nor allow do rally.
He say make pipo relax as INEC steady to make sure say this election no karey any wayo and woruworu.