The PDP govinorship candidate for Kogi State, Senator Dino Melaye don troway anoda one give govinor Nyesom Wike of Rivers State.
The gbege between Dino And Wike start wey Woke say make dem nor give Dino the PDP govinorship ticket for Kogi state.
Wike tok say Dino nor get anytin for bodi to take be govinor for Kogi State.
But wey Dino come dey reply Wike, he say the resin Wike dey vex na cus he nor fit get the party ticket for 2022 and Atiku Abubakar nor gree make an he running mate.
He clinched the party’s ticket on Monday to run for the November 11 governorship election.
For Arise Television program on Wednesday nai Dino come say Wike na ogogoro man wey dey use hard drugs and he nor get time to tok about that kind pesin.
He tok say: “Wike wey go soon komot from market nai I wan dey disturb myself about, na afta election sickness dey worry am.
“Na my election dey my head so that I fit save my Kogi pipo from where dem dey.
“I nor get time for pesin wey dey do drug and drink anyhow.”