NARD, Take Time Or We Hire New Dokitors – FG

The fediral govimet say dem nor go take am jetejete at all with dokitors wey say dem wan strike.

FG say na for dem eye korokoro like this nai dem go hire dokitors, then use the salary of the dokitors wey strike take pay the new dokitors wey dem hire.

Na for Channels Television program nai tthe Minister of Labour and Employment, Chris Ngige, take yarn so.

Remember say National Association of Resident Doctors (NARD) start five days warning strike on Wednesday cus of wetin dem ask FG wey dem never fit get for years.

Ngige say NARD just nor get respect for Nigerian Medical Association (NMA) wey don already which was already negotiating with the government on its behalf.

“This resident doctors so still join NMA. Dem be young dokitors wey still dey for training. So if NMA as the main bodi dey beg for dem back, wetin this young dokitors dey do na to disrespect NMA. Dem just dey cry for wetin nor really happen.”

 

 

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM